Francisca While everybody dey flaunt dem British English
Francisca
While everybody dey flaunt dem British English
wey dem mix with Igbotic Aba accent,
Francisca carry waka enter center,
water down our supri supri with beta Pidgin English.
Bros, see lines wey make brain
Verses wey dey turn head
Na so me I carry hand for head
like sey bubu miss road jam atiku for bending corner
Funke!
Music neva start,
me sef don dey dance.
E come be like sey na Warri pikin
dey knack us punchlines.
I swear, girl's hot!
Your first impression was impressive, Francisca.
Dey write dey go!
Notin do you jor
Aba!
#AbaStorytellingHangout
#DiaryOfAPastorsSon
#Pengician #SSA
(0) Comments
Send Your Comment
Your email address will not be published. Required fields are marked *